Affirming It : A Freewrite

Wetin make Chelsea fans talk say una do Dem?Guys...I want upload word docs on twitter..I'm not seeing a specific directionNa u miss the directions naa.

Enter moto wey dey go Oshodi, once u reach under bridge drop and cross to the other side.

U go see moto wey park for one side dey shout mushin mushin, go there make u tell them say na AP u dey go.

Once u locate AP junction, take a walk small to front, u go see bike men one side for the junction. Take bike say u dey go ayinke close

That's allWell, I think a Barca person will be the best to respond to this. Isn't it?You promised to do some research on him. I guess u av done dat.

Well, ofcourse u know dat till tomoro, by God's grace, I nor believe say coach or player must get big name or records b4 he is classed as top quality.

Only advise be say, I hope Liverpool ready o, incase.

I told Wale here, immediately Xavi was signed, that Barca is officially undergoing a rebuild, meaning results wud dwindle. Ah he no gree, he was spitting fire, that he no wan hear rebuild– all those kain rebuild wey dey affect results. He say those kain rebuild na Arsenal portion, say Barca nor be Arsenal level.

As they won La Liga ah baba no let this place rest. I come back, congratulate am, but con tell am say make d title nor deceive am. Ah he hala again, say na nonsense I dey talk.

Now I ask, what is going on now in Barca? Same rebuild.

I never tok yet say na rebuild Liverpool don enter so o, but it can happen that immediately he starts work, results may not be as positive as when Klopp was there, una ready to bear am?

Arsenal, hnmn nor look Arsenal o. These are fans, some dey don admit them for hospital becos of Arsenal wahala, dey discharge them, yet they remain with Arsernal. Na Arsenal be "Patience Prof Emiritus" they can wait and go tru the highest pains. Una fit?

My guys for house, as Poch come I tell dem make dey relax, say result no go come instantly. They hala, say nothing like that, say Chelsea na Chelsea.

I for advice some of this big clubs to kuku go for the well known big name coaches, to save their hearts o.

Well una all the best, wetin man pikin fit do.🤷‍♂️

Cheers o



0
0
0.000
0 comments